President Yoweri Museveni win Uganda election to extend im 40 year rule

Yoweri Museveni wey don dey power since 1986, dey find a seventh term

Wia dis foto come from, AFP via Getty Images

Wetin we call dis foto, Yoweri Museveni wey don dey power since 1986, dey find a seventh term
    • Author, Wycliffe Muia
  • Read am in 3 mins

President Yoweri Museveni don dey declared as di winner of kontri election wey happun on Thurssday. Dis go mean say di president wey don alreadi dey office for foty years, get anoda five years.

According to di election commission, e win with 72% of di vote as against im closest challenger Bobi Wine wey get only 25%. Wine don call out di statements say na "fake results".

Wine also don call on Ugandans say make dem do non-violent protests.

Museveni na 81 years old man wey enta power as rebel leader for 1986 and since dat time im don win seven elections.

Dem kill at least seven Ugandan opposition supporters overnight for circumstances, wey no clear as President Yoweri Museveni bin dey take a strong lead inside results from Thursday presidential election.

Di opposition say security forces attack dem for di house of one MP for Butambala, about 55km (35 miles) south-west of di capital, Kampala, while police blame di violence on di opposition.

Di 43 year old former popstar, Bobi Wine say dem kill at least 21 pipo for di elections process wey bin get plenti kasala by authorities don confam seven deaths.

Im home for Kampala don dey surrounded by security forces "wey put im and im wife under house arrest", Wine National Unity Platform (NUP) tok.

Di internet shutdown wey dem impose earlier in di week mean say news of di violence just dey come out on Friday for Uganda.

Opposition MP Muwanga Kivumbi tell AFP news agency say soldiers and police fire tear gas and den live bullets give hundreds of people were dey follow early results for im house.

"Dem kill ten were inside my house," e tok.

Human rights activist Agather Atuhaire confam am give Reuters news agency.

However, local police tok-tok pesin Lydia Tumushabe deny am, e maintain say police fire in self defence after one "group of NUP goons" bin attack one police station and plan to overrun one tallying centre.

She tell Reuters say dem bin carrying machete, axe and box of matches and say at least seven people die.

Meanwhile, some local journalists say security forces don block dem from accessing di opposition leader house for Kampala Magere area.

"Security officers don unlawfully jump over di perimeter fence and now dey set up tents within im compound," NUP post on X late on Thursday.

Police spokesman Kituuma Rusoke tell local broadcaster NBS say as a presidential contestant, Wine na "a person of interest", adding say di heavy security deployment around im house na for im own security.